US navy attack and seize Iranian cargo ship, peace tok go take place for Pakistan

Wia dis foto come from, Aamir QURESHI / AFPand IRANIAN PRESIDENCY / HANDOUT via Getty Images
Di US attack and seize cargo ship wey belong to Iran wey dey try attempt to get past dia blockade of Iran ports, President Donald Trump say.
Trump say dem give di ship "fair warning to stop" but di crew "refuse to listen, so our Navy ship stop dem right for dia tracks by blowing hole for di engine room"
"Vacate your engine room, vacate your engine room, we dey prepared to subject you to disabling fire," dat na wetin dem tell di Iranian ship bifor dem seize am.
Trump say na US forces bin stop di Iranian-flagged cargo ship and dem don take control of di vessel, afta Iran try get di vessel through di US blockade.
Dem stop di ship, Touska, for di Gulf of Oman by di USS Spruance.
Trump say di ship dey under US Treasury sanctions "becos dia history of illegal activity".
Meanwhile, Iran military say dem go do dia own back as Iranian media say drones don attack US ships, though no damage dey reported
Di US and Iran dey due to hold peace tok for Pakistan today Monday, wit US Vice-President JD Vance leading di US delegation
No decision on latest US tok- Iranian spokesman
Iran neva decide yet weda dem go attend second round of negotiations wit di US, one tok tok pein for Iran foreign ministry say.
Di Iranian tok tok pesin say dem get "no plans for di next round of negotiation, and dem neva make any decision" on weda dem go attend
"As of now... we no get plans for di next round of negotiation, and no decision don dey for dis regard," tok tok Esmail Baghaei say, for im translation from di AFP news agency.
Di US-Iran two-week ceasefire dey due to end on Wednesday. On Sunday, Trump again threaten to strike Iranian power plants and bridges if dem no reach deal.
President Trump say e dey send delegation to Pakistan led by Vice-President JD Vance for di Monday tok.
Trump Middle East Envoy Steve Witkoff and son-in-law Jared Kushner also dey due to attend.
Iran go attend di peace tok?
Tok between di US and Iran dey due to begin for Pakistan capital, Islamabad, later today.
Dem don ask make guests for di city Serena Hotel, wia di last failed peace tok hold on 11 April, to comot in preparation of today meeting.
Police don also announce di closure of key roads sake of di arrival of foreign delegations.
As Trump tok say im US delegation go land for Pakistan, Iran neva formally confam weda dem go attend di tok.
Di kontri state media report say dat officials no go participate for di tok while di US block Iranian ports.










