Who be Obafemi Hamzat wey Sanwo-Olu 'anoint' to be next Lagos State govnor

    • Author, Gift Andrew
    • Role, Reporter
  • Read am in 3 mins

No be news again say Lagos state govnor don endorse him deputy Obafemi Hamzat to replace am for office wen him conclude him tenure next year.

If him succeed and win, e go be di first time sitting deputy govnor go become govnor for di state since 1999.

Govnor Sanwo-Olu say di decision to support him deputy na unanimous decision by stakeholders and members of di Lagos Govnors Advisory Council (GAC).

Videos wey trend on Monday show moment govnor Sanwo-Olu dey pray for oga Hamzat dey bless am, say im be pesin wey dey ready and prepared for di job.

E lift him hand as sign of endorsement.

Earlier for April, Obafemi Hamzat bin dey post pictures wey show wia im dey do consultations wit stakeholders for various locations for Lagos.

Though im don get di approval of him boss, Nigeria law provide say im go first win im party primary bifor e go follow contest for di forth coming Lagos govnorship election.

Tori for town be say former govnor of Lagos state who now be Nigeria president Bola Tinubu - who be di first govnor of Lagos State afta di military hand ova to civilian rule for Nigeria in 1999 - dey usually give im approval for who go be di govnor of di state.

E neva clear weda di president don giv im approval for Hamzat, but political sabi pipo say Sanwo-Olu no for publicly announce im deputy if Presidon no give im go-ahead.

Dis also mean say e don almost sure say Amzat go be di govnorship candidate for di ruling All Progressives Congress (APC) for Lagos State, according to wetin analysts tok.

Also, oga Hamzat bin don do consultations wit Femi Gbajabiamila wey be di Chief of Staff to President Tinubu and im right hand man, plus oda members of di GAC wey be di team wey dey usually select who go be di govnor for di state since di past two decades.

Di man Obafemi Hamzat

Di name Obafemi Kadri Hamzat start to dey popular just bifor di 2019 govnorship election for Lagos state as e bin follow contest for dat election under di All Progressives Congress APC.

Howeva, e later step down for im now boss Babajide Sanwo-Olu who bin go ahead to win di APC primary and also di govnorship election as Hamzat become im deputy.

Bifor dat, im bin serve as Commissioner for Science and Technology for Lagos state unda President Bola Tinubu wen e be govnor of di state for 2005.

Wen BabaTunde Fashola take ova as govnor for 2007, e retain Amzat as commissioner, bifor e later serve as commissioner for works and infrastructure from 2011 to 2015.

E also serve as Special Adviser on Works to di Minister of Works, Power and Hoising from 2015 to 2018. Na after dat e announce say im wan run for govnor of di state.

Obafemi Hamzat na Muslim. Im be technocrat and get Ph.D for engineering from Cranfield University for UK. Na also alumni of University of Ibadan.

Before e come back to join politics for Nigeria, e bin dey work for big firms for New York, and also for Oando PLC, di biggest indigenous oil company for Nigeria.

E get better experience for IT, public service and infrastructural development.

Dem born Hamzat for September 19, 1964. E hail from di Iga Egbe axis of Lagos State. E from a royal family as him papa na king bifor e die.

Im papa, di Late Oba Mafutau Olatunji Hamzat bin serve as member of Lagos State House of Assembly and also as Commissioner for transportation for Lagos state and later become King.

Hamzat dey married Oluremi Hamzat to and dem get 3 children.