US block Iranian ports as Trump say Tehran want make deal 'veri badly'

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
US blockade of Iran ports don begin - Donald Trump bin say e go start at 10:00 ET (14:00 GMT / 15:00 BST).
For di White House, di US president say Iran want make deal "veri badly" and add say di "appropriate pipo" call am dis morning dey seek agreement.
For one social media post, di US president warn say any Iranian "fast attack ships" wey dem catch dey try approach di blockade "go dey immediately ELIMINATED".
Earlier, Iran parliament speaker say di kontri no go "surrender under threats" - response neva dey to Trump latest remarks.
Di UK Maritime Trade Operations (UKMTO) bin issue one advisory, wia dem say ships for di area fit encounter a "military presence" and "right-of-visit procedures during passage".
President Trump tok say direct toks wit Iran for Pakistan fail becos Iran dey "unwilling to give up dia nuclear ambitions" - but one US official tok say dem get longer list of disagreements, including on Iran control of di strait.
Di plan na to make Iran oil economy collapse but dis blockade go also stop Iran from collecting money from oil tankers wey wan use di waterways.
Strait of Hormuz na important waterway, about 20% of global oil dey pass through – and di closure by Iran don drive up oil prices and di world economy don dey impacted.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di strait na Iran most effective weapon for dis war against di US. Since di war start on 28 February, Iran don block di waterway.
Trump say timeline to deal wit Iran war neva change

Wia dis foto come from, Tom Williams/CQ-Roll Call, Inc via Getty Images
Trump say im timeline to deal wit dis conflict neva change.
"Right now, fighting no dey," e tok. "Right now we get blockade, dem no dey do business," e tok, referring to di Iranians.
"I bin no like to dey see di boats come out, if dem dey do business wit Iran," e tok, seemingly in reference to vessel traffic for di Strait of Hormuz during di ceasefire.
Di Iranians dey currently do no business for di strait, Trump tok, and "we go keep am dat way, veri".
Wetin Trump tok about di blockade of Strait of Hormuz?
Trump write for social media on Sunday say US go start "BLOCKADING any and all Ships wey dey try enta or comot from Strait of Hormuz".
"I don instruct our Navy to seek and interdict evri vessel for International Waters wey don pay toll to Iran. No one wey pay illegal toll go fit pass safely for high sea," e tok.
E add say US go start to destroy di mines e tok say Iran don lay for di strait.
"Any Iranian wey fire at us, or at peaceful vessels, go dey BLOWN TO HELL!" e continue.
Trump say "at some point" dem go reach an agreement on free passage but "Iran neva allow am to happun by merely saying, 'Mine fit dey out dia somwia, wey nobodi know about but dem".
E add for anoda post say "Iran promise to open di Strait of Hormuz, and dem knowingly fail to do am".
"As dem promise, dem beta start di process to open INTERNATIONAL WATERWAY SHARP SHARP!" e tok.












