Dominican Republic Joheirry Mola win Miss World 2026 beauty pageant

Wia dis foto come from, Ivan Apfel/Getty Images
Joheirry Mola of Dominican Republic don win di Miss World crown for her home kontri.
Di 24-year-old, model win di competition on Saturday evening for Vietnam, wia di international pageant hold dis year.
Mola win di second crown for Dominican Republic as Mariasela Alvarez bin win di kontri first crown for 1982.
Mola win against 111 contestants wey also contest in di competition wey hold for Nha Trang city, Vietnam.
Elisabeth Reynes Alabern of Spain na di first runner-up for di competition and Miss Malaysia, Taanusiya Chetty emerge as di second runner-up and winner of di beauty-with-purpose competition.
Eritera, Malaysia, Vietnam, Dominican Republic, Spain and South-Africa make am to di final rounds as di top six in di Miss world competition.
Nigeria contentant, Tamunosoye Karibi-George, also reach di top 12 through di People's Choice Award in di competition.
Julia Morley, CEO of di Miss world organisation annouce di winners and runner-ups on Saturday.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di event start around 9:00pm Hanoi time zone (2:00 WAT time zone) for Nha Trang city, Vietnam.
Opal Suchata, last year winner crown di 73rd Miss World winnner, Joheirry Mola .
Miss world competition mark dia 75th anniversary as dem hold di 73rd Miss World beauty pageant competition for Vietnam. Di competition start wit 111 contestants on August 8, 2026 and end tonight on September 5, 2026.
Mr World 2024 Daniel Mejía from Puerto-Rico and Miss world 2016 Stephanie del Valle host di event.
Nigeria contentant, Tamunosoye Karibi-George, also reach di top 12 through di People's Choice Award in di competition but lose to Miss Eritera.
Di 26-year-old also win di top model competition for Africa continent during di competion while Miss South-Africa, Romanda Hombir emerge di continental winner for Africa.
Di competition start wit di beautiful ladies from 111 kontris dressed in dia beautiful evening gowns shortly afta dem change into beauty Vietnamese Áo dài, lovely styled dress and trouser as di host annouce di top 40 in di competion.
Di list include di winners of top model, beauty-with-purpose, talent, sports, People's Choice Award and di judges choice.
Tanazania go hold di 74th Miss world competition.
Profile of 24-year-old Joheirry Mola
Joheirry Mola, na 24-year-old teacher, journalist community advocate from Santo Domingo
She be graduate of Business Management and Administration from Universidad Iberoamericana (UNIBE).
She establish one social initiative - di Voices of Tomorrow to help children and young pipo for her community to expand dia knowledge of English education. Di aim of di project na to give young pipo greater access to opportunities, confidence and tools for dia future.
Mola represent Distrito Nacional wen she win di Miss World Dominican Republic title for 2025. She be di winner of di top model competition for Americas & Caribbean continent and she finally win di crown afta she earn her spot for di top 40 for di Miss World 2026 final for Vietnam.
Education na main part of Mola work as she dey teach Literature and Social Studies for schools.
Mola also dey involved in community programmes wey dey support children. In March 2026, she bin work as live reporter for Univision, during di UNICEF telethon for di Dominican Republic for May 2026, wia dem help promote di campaign to raise $24.752 million for programmes to support children.














