Mbappe, Messi or who go win di 2026 World Cup golden boot?

Published
Read am in 4 mins

Di biggest World Cup tournament don enta di business side of tins, wetin football pundits describe as 'crunch time'.

Dis tournament get many history-making events.

Apart from di fact say three different kontris dey host am, di number of teams (48) na di largest number of teams for any World Cup for history.

Also di first time 10 African kontris play for di tournament.

For dis tournament, many goalkeepers shine well well.

Keepers like Vozinha (Cape Verde), Orlando Gill (Paraguay), Gregor Kobel (Switzerland), Raul Rangel (Mexico), Diogo Costa (Portugal), Benjamin Asare (Ghana) among odas make many saves for dia teams.

Some young players also shine so far – players like Gilberto Mora (Mexico, 17), Johan Manzambi (Switzerland, 20), Ayoub Bouaddi (Morocco, 18) among odas.

Na so di golden boot race also make tight – di big boys dey show working for dia teams.

As many as 10 players get between three and eight goals, but some don crash out already.

Kylian Mbappe don join Lionel Messi for eight goals for dis summer World Cup, while Erling Haaland and Harry Kane dey chase dem from behind.

But even Haaland crash out afta Norway lose to England for di quarterfinals.

Di football superstars dey deliver for di biggest stage, as dem dey set hot pace for di race to bicom di tournament top goalscorer for USA, Canada and Mexico.

Messi bounce back afta e miss penalty against Egypt, e help Argentina complete one historic comeback by scoring three goals for di final 13 minutes to qualify for di quarter-finals.

Mbappe too do almost di same tin against Morocco for di first quarter-final match. E miss penalty afta kicking di ball for di same direction as Messi, bifor e later score France opening goal shortly afta one hour of play.

England captain Harry Kane follow wit six goals afta im penalty help England beat co-host Mexico 3-2.

Jude Bellingham join di list afta im two goals help England beat Norway. E no dey six goals.

If any of di players tie for di number of goals, dem go check which of dem get di most assists aside di goals, di pesin wit di most assists go dey declared as di winner of di golden boot.

If dem still no get winner, dem go check di number of minutes each of di players bin play for di tournament; di player wit fewer minutes go dey awarded as di winner.

If afta dis, di players still dey tied, den dem all go share di golden boot award.

But as knockout games still dey go on wey di tournament dey drag towards di final, which of dis players fit win dis golden boot?

Messi, Mbappe, Kane or Haaland? But Haaland is out.

Time go tell.

Highest goalscorer for 2026 World Cup

  • Mbappé - France - 8 goals
  • Messi - Argentina - 8 goals
  • Haaland - Norway - 7 goals
  • Bellingham - England - 6 goals
  • Kane - England - 6 goals
  • Dembélé - France - 5 goals
  • Mikel Oyarzabal - Spain - 4 goals

Fifa World Cup golden boot

2002 – Ronaldo (Brazil) – 8 goals

2006 – Miroslav Klose (Germany) – 5 goals

2010 - Thomas Muller (Germany) – 5 goals

2014 – James Rodriguez (Colombia) – 6 goals

2018 – Harry Kane (England) – 6 goals

2022 – Kylian Mbappe (France) – 8 goals

2026 - ?