You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Fifa World Cup 2026 quarter finals fixtures, standings and results
Di Round of 16 for di 2026 Fifa World Cup don end as players and coaches go begin strategise and plan for di quarter-finals wey go start on Thursday.
Qualifications for di last eight no too easy like dat as two kontris fight hard to qualify on di last day.
One of di kontris na defending champions Argentina wey fight hard to comeback from 2-0 to beat Egypt for 3-2.
Di Pharoahs bin dey lead 2-0 afta Egypt bin save Lionel Messi penalty bifor Argentina shock dem bifor full time wey match Egypt cry for match wey get plenti controversy.
For di second match between Switzerland and Colombia, nobody gree for each oda untill e enta penalty shootout.
Switzerland beat Colombia 4-3 on penalties to qualifty for di last eight.
Kontris wey don qualify for di quarter-finals na defending champions Argentina, Norway, France, Spain, Belgium, England, Morocco and Switzerland.
Morocco na di only African kontri wey remian for di World Cup, all eyes dey on dem dem go fit reach di dia semi-final round as dem bin do for di 2022 World Cup for Qatar.
Dis World Cup don shock plenti pipo as big names for world football don crash out.
On Monday, former World Champions Spain shock Portugal wit 1-0 win wey remove Cristiano Ronaldo from dis World Cup wey im already tok say go be im last.
Belgium do USA wetin no good, dem sama di co-host 4-1 inside di red card controversy wey Fifa change afta President Donald Trump tok say im call dem to cancel di red card for Folarin Balogun.
Belgium end di dream of US to win dia first ever World Cup.
Morocco and France go play di first match for di quarter-finals stage on Thursday, Spain and Belgium go play on Friday.
See di full results and fixtures here.
Wetin to know about di 2026 Fifa World Cup
Di 2026 Fifa World Cup start on 11 June wit di opening match between Mexico and South Africa.
Di tournament dey hold for three kontris - USA, Canada and Mexico fo end of 19 July.
Dis na di di first time in history wey di World Cup go get 48 teams and three host kontris.
Bifor now na 32 kontris bin dey participate for di World Cup tournament. Dis expansion allow some kontris wey neva qualify for di tournament bifor to participate.
Dis 23rd edition promise to dey exciting as e dey fill wit a mixture of old, middle age and young players from different kontris.
As dey excitement dey come, e also carry sadness sake of say some ogbonge players for di tournament to use di World Cup end dia career for international football.
Di tournament also get new ball wey get microchip inside wey dey read 500 times faster and di ball dey rechargeable.