Pastor Adeboye respond to allegation say e campaign for Tinubu, clear air on protest e participate in during Jonathan administration

RCCG General Overseer Pastor E.A. Adeboye wear brown suit and hold microphone

Wia dis foto come from, RCCG/X

Published
Read am in 5 mins

Di Redeemed Christian Church of God (RCCG) wey be one of di largest Pentecostal Church for Africa don clear di air on wetin dem call "false narratives" wey dey spread about di Church and di General Overseer Pastor Enoch Adeboye.

Di church say tori say RCCG bin campaign for di ruling All Progressives Congress (APC) govment no be true.

RCCG Public Relations Unit for one statement on dia official X account on Tuesday, 2 June clear am say Pastor Adeboye instead dey always encourage members of di RCCG to collect dia Permanent Voters Card and vote for anyone of dia choice.

Recently, di church bin enta public eyes as some Nigerians drag dem ontop one alleged planned protest wey dem cancel and di call from some pipo for di removal of Nigeria First Lady Remi Tinubu as Pastor for di church, plus oda tins.

Di church don respond to di accuse and add say: "Pastor Adeboye and di RCCG no go dey defined by falsehood, and di church no go remain silent while inaccurate narratives dey repeatedly circulate as facts."

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Pastor Adeboye cancel planned protest

Recently, tori bin spread say di 84-year-old General Overseer bin cancel one protest against insecurity for di kontri and di kidnap of school children for Oyo State.

RCCG say dat no be true as wetin di cleric tok about di rally na di instruction wey di Pentecostal Church of Nigeria (PFN) give to all di churches wey dey under am.

"Pastor E.A. Adeboye bin only communicate di instruction of di Pentecostal Fellowship in Nigeria to members of di RCCG on di updated plan to get di grand finale of di three-day prayer programme for one centralised venue and hold rally around di venue."

Many pipo don drag di GO say e lead, carry placard and protest against di administration of former president Goodluck Jonathan, but for President Bola Tinubu administration, e silent as e no organise im members to rally against di insecurity kontri pipo dey face under di current administration.

Di church for dia response explain say di waka for Ebute Metta, wey Pastor Adeboye participate inside na part of one nationwide exercise wey di Christian Association of Nigeria (CAN) bin organise.

"Di church no organise di protest against President Goodluck Jonathan and e no in anyway dey connected to im administration," di statement tok.

Pastor Adeboye message during di waka dey clear and na say all lives mata to God. "Im placard emphasise di value of evri human life, regardless of religious affiliation. Di call na for di protection of innocent Nigerians, both Christians and Muslims", di statement add.

Di cleric also hold peaceful nationwide waka in response to di directive wey di Christian Association of Nigeria (CAN) issue during di administration of di late president Muhammadu Buhari.

"Churches across Nigeria bin dey instructed to hold peaceful waka afta service, to call di attention of di govment to di persistent killings of Christians and urging dem to take decisive action to protect lives.

Allegation say Pastor Adeboye intentionally dey quiet on tins wey dey happun for Nigeria

Di church also dismiss allegations say Pastor Adeboye intentionally dey silent on developments for di kontri. RCCG say di cleric no dey silent.

Pastor Adeboye na one cleric wey dey vocal on national issues and wey dey always call govment attention to tins wey no dey go on well for di kontri. But, recently pipo don accuse am say e turn blind eye to Tinubu administration. Some allege say na becos of dia same ethnic group and religious affiliation wit di President wife, Oluremi Tinubu, wey be pastor for di church.

Di church for di statement clear am say di cleric on several occasions, don publicly address issues wey concern insecurity, corruption, economic hardship, elections, governance, plus di need for righteous leadership.

However, most times, e dey choose di language of moral guidance, prayer and counsel, instead of partisan political confrontation.

During di November 2025 Holy Ghost Service, Pastor Adeboye bin publicly advise di President of Nigeria ova di worsening security situation and di continued killing of innocent citizens by terrorists. E warn say govment gatz take urgent action bifor foreign powers find solid reason to intervene for Nigeria under di guise of combating terrorism.

E also say make govment give security chiefs clear ultimatum to decisively address di mata or vacate dia positions.

Calls for di removal of First Lady Oluremi Tinubu as Redeemed pastor

Recently, di church don face pressure to remove Nigeria First Lady Oluremi Tinubu as pastor for Redeemed Christian Church of God.

Pastor Adeboye say di church no go remove her from her position as she be ordained pastor for di church.

Di cleric wey give dis informate for di May Holy Ghost Service explain say di First Lady dey ordained as Assistant Pastor more dan ten years ago, long bifor her husband Bola Tinubu show any intention say im wan run for di presidency.

E clear am say di First Lady go through di full process of ordination and she no violate any of di church guidelines, as e add say di church no go bow to external pressure wey dey call for her removal.

Di church also clear am say di calls for di cleric to command di President and di First Lady on how to run di affairs of di kontri dey both unrealistic and unreasonable.

"Pastor Adeboye na clergyman, no be di Commander-in-Chief of di Armed Forces."

Di church also highlight am say Pastor Adeboye and RCCG no dey responsible for di current challenges di kontri dey face, RCCG no be political party. Di GO no hold any political officer and no dey elected into govment. Lastly, di church no be di religious arm of any political party for Nigeria.